Forum » Off-topic » DAILY JOKES | Date | |
---|---|---|
Username
2032 msgs.
Best scorer
|
In a WAEC Examination Akpos was asked to complete the following: . . . 1. He who fights n run away? Akpos: e don surrender be dat na, na fear catch am. 2. A rolling stone? Akpos: No fit just dey roll, na person push am. 3. He who lives in a glass house? Akpos: Na rich politician e go be. 4. A stitch in time? Akpos: dey prevent further tear tear. 5. Birds of d same feather? Akpos: Na d same mama born them. 6. One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am. 7. A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if nobe barbeque. Dem plenty for chicken republic. 8. Half bread is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar. 9. A journey of a thousand miles? Akpos: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje! 10) He who laughs last? Akpos: Get brain problem. Make dem examine ambecos na begining of madness be dat. 11. A patient dog? Akpos: Na hunger go kill am. 12. All work and no play? Akpos: Na bank job be dat bros. 13. Once beaten? Akpos: Na revenge go follow b dat. 14. A fool at forty? Akpos: U never see Naija own, ours starts @ 50. 15. A friend in need? Akpos: Na parasite b dat. Will akpos pass the exam??? Pls, mark his script for him!!! |
21/07/2012 02:43 |
- Div/Gr | ||
3168 msgs.
Best scorer
|
I understood nothing. | 21/07/2012 11:33 |
- Div/Gr | ||